The Syrian Observatory For Human Rights

SOHR: Turkey earthquake: Death toll for Turkey and Syria earthquake don pass 9000

 

Di total number of pipo wey don die afta di earthquake wey hit Turkey and Syria now don pass 9,000.

And for inside di freezing cold temperatures, reports say di death toll fit continue to rise.

Di number of pipo wey die for Turkey don rise to 6,957 according to di kontri disaster agency.

E dey difficult to verify di number for Syria, but di state media and one rescue group say about 2,500 pipo don die.

Rescuers dey desperately search for survivors for southern Turkey and northern Syria afta two ogbonge earthquakes on Monday.

Dis dey come afta Turkish President Recep Tayyip Erdogan announce three-month state of emergency for 10 provinces wey di earthquake affect well-well.

For one televised address, Erdogan say di state of emergency na to make sure say dem fit carryout rescue work “quickly” for south-east of di kontri.

E say di measures go allow relief workers and financial aid into di affected regions, but e no further details.

Di state of emergency go end just before elections on 14 May, wen Erdogan go attempt to stay in power afta 20 years.

Turkey last impose state of emergency for 2016 afta one failed coup attempt. Dem lift am two years later.

Turkey declare 7 days pf mourning

Turkey declare seven days mourning to mourn dos wey die from di disaster.

President Recep Tayyip Erdogan tweet say, “National mourning period don dey declared for seven days. Our flag go fly for half-mast until night for Sunday 12 February, 2023, for all our national and foreign representative offices dem”.

Plenti kontris don promise aid since di 7.8 magnitude quake wey knack di kontri as pipo bin dey sleep and inside dressing weather wey don affect emergency efforts.

Multi storey buildings full of pipo inside dey among di number wey di earthquakes collapse for Turkey, as Syria tok say dem find dozens of building collapse and damage for di Aleppo archaeological sites.

Second earthquake of 7.5 magnitude tremor hit Turkey and Syria around 1:30pm local time on Monday, wey officials say no be aftershock.

Meanwhile Russia President Vladimir Putin, don offer condolence and pledge to give di two kontris aid.

Putin tell Syria President Bashar al-Assad: “We hope for speedy recovery for all di injured and dey ready to provide di assistance wey una need to overcome i impact of dis natural disaster,” AFP news reported.

Schools for di 10 cities and provinces across Turkey wey di earthquake affect go dey closed for one week, di kontri vice president Fuat Oktay tok.

Di cities and provinces na Kahramanmaraş, Hatay, Gaziantep, Osmaniye, Adıyaman, Malatya, Şanlıurfa, Adana, Diyarbakır, Kilis.

Turkish Vice-President Fuat Oktay, say dem don suspend flights wey wan enta or comot di airport for Hatay province, dem don also close di airports for Maraş and Antep to civilian flights.

Syria health ministry say pipo bin die for di provinces of Aleppo, Latakia, Hama and Tartus.

Di US Geological Survey say di 7.8 magnitude tremor strike at 04:17 local time (01:17 GMT) at a depth of 17.9km (11 miles) near di city of Gaziantep.

Human rights group dey monitor situation

UK-based Syrian Observatory for Human Rights don update dia preliminary death toll to 783 for di whole of Syria.

Meanwhile help don dey come di way of Turkey in di wake of di earthquake incident, Dutch PM Mark Rutte don announce say one Dutch search and rescue team go join di hunt for survivors for Turkey and Syria. For inside one tweet, e also share im condolences to Turkey president Erdogan, saying: “Thoughts dey wit all victims of di serious natural disaster.”

Greek Prime Minister, Kyriakos Mitsotakis, say Greece go also “mobilise dia resources” and assist di affected areas “immediately”.

Di leaders of Serbia and Sweden don also promise to send help to di region.

Israel foreign minister Eli Cohen say dem don arrange one fast aid programme. Dia defence minister Yoav Gallant say Israeli security forces dey ready to offer any assistance needed, Reuters report.

Some parts for Israel and di Palestinian territories also feel di tremors from di quake.

For Turkey, officials bin confam more more dan 76 deaths and 10 cities wey dey affected, including Diyarbakir.

Fears dey say di death toll go rise sharply in di coming hours.

Many buildings don collapse and dem don send rescue teams to go search for survivors under big pile of rubble.

Turkish Interior Minister Suleymon Soylu say 10 cities dey affected: Gaziantep, Kahramanmaras, Hatay, Osmaniye, Adiyaman, Malatya, Sanliurfa, Adana, Diyarbakir and Kilis.

As at di time of dis report, tori be say at least 2,323 pipo injure for Turkey and 639 for Syria.

One BBC Turkish correspondent for Diyarbakir, report say one shopping mall for di city don collapse.

Pipo for Lebanon and Cyprus also feel di earthquake.

“I bin dey write sometin and just all of a sudden, di entire building start dey shake and yes I no really know wetin to feel,” Mohamad El Chamaa, one student for di Lebanese capital Beirut, tell BBC.

“I dey right next to di window so I just dey fear say dis window fit break. E go on for four-five minutes and e dey bad well-well. E dey mind-blowing,” e tok.

Rushdi Abualouf, one BBC producer for di Gaza Strip, say di house wia e dey stay shake for about 45 seconds.

Turkish seismologists estimate di strength of di quake to be 7.4 magnitude.

Dem tok say dat na di second tremor wey go hit di region just minutes later.

Turkey lie for one of di world’s most active earthquake zones.

For 1999, more dan 17,000 bin die afta one powerful tremor bin rock di north-west of di kontri.

 

Source:  BBC